Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 13:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 Dem kom back kom meet Moses, Aaron and Israel pipol for Paran Wildaness wey dey Kadesh kon tell dem evritin wey dem si and show dem di fruit wey dem bring from di land.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 13:26
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den dem go fight En-Mishpat (wey bi Kadesh) and dem win evry kountry wey dey for Amalek aria, even Amor pipol wey dey stay Hazazon Tamar.


God vois dey make di wildaness shake. Yes! En vois dey shake Kadesh Valley.


Den, dem kon kom back afta forty days, wen dem don shek di land.


So Moses send dem komot from Paran Wildaness, just as God kommand. All di men wey e send, na leaders for Israel.


For di first mont, di whole kommunity for Israel go Zin Wildaness kon stay for Kadesh. For der, Miriam die and dem kon beri am.


Moses kon send message from Kadesh go give Edom king sey: “Di message na from yor broda Israel: Yu know all di sofa wey wi dey sofa,


So wen wi kry to God, E hear awa vois kon send messenja, wey kom take us komot from Egypt. Naw, wi dey Kadesh, di town wey dey una kountry side.


Una papa do di same tin wen I send dem from Kadesh Barnea go si di land.


Wen dem si di land from Eshkol Valley, dem kon diskorage Israel pipol, so dat dem nor go enter di land wey God don give dem.


Dem travel from Ezion-Geber go Zin Wildaness, wey bi Kadesh.


Den just as God kommand us, wi komot from Mount Horeb kon travel pass di great wildaness wey dey make pesin fear, just as unasef go remember, den wi face Amor pipol kountries. Wen wi rish Kadesh Barnea,


Na eleven days journey e suppose bi from Horeb to Kadesh Barnea wen dem pass thru Mount Seir.


Judah men kom meet Joshua for Gilgal and Kaleb wey Jefunneh wey kom from Kenizz born kon tell Joshua sey, “Yu know wetin God tell Moses en savant for Kadesh Barnea about yu and mi.


I bi forty years wen Moses, God savant send mi from Kadesh Barnea go spy di land and I kom back kon tell am di trut.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ