20 weda di land dey rish or poor; get forest or not. Make una dey strong kon bring some fruit wey dey di land kom.” Naw, dis na di time for di year wen di first grape dey ripe.
Yor pipol seize strong-strong towns; betta-betta land; house wey propaty full; well wey dem don dig; olive trees; fruit trees and vineyards. Dem chop anytin wey dem wont kon fat and dem enjoy all di good tins wey Yu give dem.
Even wen dem get dia kingdom, dem nor gri serve Yu, doh Yu still show dem yor goodness. Yu give dem betta land to plant, yet dem nor gri turn from dia wikedness.
E nor go warn towns wey get money before e attack dem and e own go worse pass wetin en grand-grand papa dem do. E go divide di propaty wey e take for war give en men. E go plan to attack sojas wey strong pass am, but en time go soon end.
and God kon make Joshua, Nun pikin leader for Israel sey, “Make yu dey strong and nor fear, bikos yu go take Israel, my pipol go di land wey I promise dem and I go dey with yu.”
I dey tok again, so dat yu go dey strong kon get heart! Make yu nor fear or shake, bikos mi wey bi di Oga yor God, I dey with yu for evritin wey yu dey do.”
Joshua kon send two pipol from Shittim kamp go spy Kanaan land especially Jeriko town. Wen dem rish di town, dem kon go sleep for one ashawo house and di ashawo name na Rahab.