E dey travel from one place go anoda, from Negev go rish Bethel. Den e kom back to di place wey dey between Bethel and Ai, where e for first put en tent.
Na Amalek pipol dey stay for di sout part for di land; na Hit, Jebus and Amor pipol dey di kountries for hill; Kanaan pipol dey near Mediterranean Sea and along Jordan River.”
Early di next morning, dem start to travel go di hill kountries kon sey, “Naw wi don ready to go di place wey God don dey tell us. Wi know sey wi don sin.”
Joshua win di whole land plus di kountries for hill, for di Negev, di lowland, di slope and all dia kings. E nor let any one live. E kill evritin wey dey breath, just as di Oga wey bi Israel God, tok.
Joshua kon send two pipol from Shittim kamp go spy Kanaan land especially Jeriko town. Wen dem rish di town, dem kon go sleep for one ashawo house and di ashawo name na Rahab.
E ansa, “Abeg make yu give mi anoda gift. Yu don already give mi land for Negev, but naw, I wont make yu give mi place where wota dey.” Den Kaleb kon gi-am di spring for up-and-down.
God dey with Judah pipol, so dem take di hill kountry. But dem nor fit drive di pipol wey dey di koast aria komot, bikos di pipol shariot, bi like iron.