Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 12:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 So Aaron tell Moses, “My oga, abeg, nor let us sofa dis ponishment bikos of awa foolish sin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 12:11
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

kon sey, “My king, abeg, make yu forget all di bad tins wey I do dat day wey yu komot from Jerusalem, nor kount am against mi or tink am at-all.


But wen David don kount di pipol finish, en heart kon dey judge am, den e tell God, “I don kommit big sin for dis tin wey I do! Abeg, make Yu forgive mi. Na foolish tin I do so.”


King Jeroboam tell di profet, “Abeg! Make yu pray to di Oga yor God for mi sey, ‘Make E heal my hand!’ ” So di profet pray to God and di king hand kon strait again.


E klear sey na God dey wosh di whole world and E dey ready to give pawa to doz wey trust am. Yu nor use sense for dis matter, so from naw go, na so-so war yu go dey fight.”


Make yu still take una sheep, goat and kattles follow body. But bless mi too.”


“If yu don do foolish tins bikos yu dey proud or dey plan evil, make yu kover yor mout with shame.


kon tell mi: “Abeg, make yu do wetin wi won tell yu so! Make yu help us wey dey alive pray to di Oga awa God. Wi many before, but naw, yusef dey si sey wi nor many again.


Di pipol kry go meet Moses make e help dem; so Moses pray to God and di fire kon stop.


Nor let us mi bi like pikin wey don die, wey e flesh don rotin before dem born am.”


Simon tell Pita, “Make yu pray to God for mi, so dat di tin wey yu tok so, nor go happen to mi.”


Listin! Doz pipol from Satan sinagog wey lie sey dem bi Jew, I go make dem bow for yor front, den dem go know sey I really love yu.


Dem kon tell Samuel, “Make yu help us pray to God, so dat all of us nor go die, bikos wi don add join awa sins, wen wi ask for king.”


“So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ