33 As dem still dey chop di meat, God kon dey vex with di pipol, so E send sickness go meet dem.
and bikos dem won enjoy di sweetness, dem nor gri komot am from dia mout.
Make God feed dem beleful with trobol. Make God pour in vexnashon for dia head like evening rain dey fall.
God release di east wind for heaven kon guide di sout wind with en pawa.
and di pipol chop beleful. E give dem wetin dem ask for.
Naw, di pipol wey die with di diziz na 14,700 plus di pipol wey die bikos of Korah matter.
So Moses do wetin God kommand am.
Doz wey die for di wahala na 24,000.
God go ponish una with boil from Egypt, some part for una body go swell-up, eczema, ring worm and kro-kro go full una body and dem nor go fit cure una.