Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 11:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 God kom down for di kloud kon tok to dem. E take some of di Spirit wey dey inside Moses kon put dem inside di seventy men. Wen di Spirit enter dem, dem kon dey profesai, but dem nor do like dat again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 11:25
28 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen di fifty student from Jeriko, si Elisha dey kom, dem kon sey, “Elijah spirit don enter Elisha.” Dem waka go meet am kon bow for en front.


Yu send yor good Spirit make e tell dem wetin dem go do and Yu nor stop to give dem manna chop and wota to drink.


E tok to dem from di kloud wey kom as pila and dem obey en kommand and laws wey E give dem.


God, make Yu forgive dem, but if Yu nor go forgive dem, den make Yu remove my name from di book wey Yu rite.”


God kom down inside di kloud kon stand der with Moses, den E koll en own holy name wey bi Oga God.


God kloud dey-dey di Tabanako for day time and na fire e dey bi for nite and evribody for Israel dey si am as dem dey travel.


Den di pipol remember as e bi before; dat time wen Moses take dem komot from Egypt, so dem ask, “Where di God wey save en pipol from di sea? Where di God wey give Moses en Spirit?


Seventy Israel leaders dey der, plus Jaazanaya wey bi Shafan pikin. Each of dem whole wetin dem take dey burn incense and smoke dey kom out from am.


I go kom down kon tok with yu, I go take some of di Spirit wey dey inside yu kon put am inside dem and dem go help yu karry some of di wahala so dat yu nor go karry am on yor own.


God kom down inside kloud, stand for di tent gate; den E koll Aaron and Miriam and di two of dem waka go front.


So Moses get up go meet Datan and Abiram and di eldas for Israel, follow am.


As Balaam look up, e si Israel pipol kamp akordin to dia tribe and God Spirit kon enter en body.


God ansa, “Make yu take Joshua wey Nun born kon put yor hand for en head, bikos na-im go fit lead dem;


One among dem wey en name bi Agabus, get up and di Holy Spirit kon put word for en mout sey, “Heavy honga go happen for di whole world.” Dis tin happen di time wen Klaudius dey rule.


Pesin wey bi profet must dey ready to stop, so dat anoda pesin go tok, bikos profet suppose to fit kontrol en own spirit,


bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.


bikos know profesy don ever kom out from human being mind. Instead, na di Holy Spirit dey kontrol di pipol wey dey tok God word.


God Spirit enter am, so e kon bi leader for Israel. E go war go fight against King Kushan-Rishataim and God kon help Otniel, win am.


Wen dem rish Gibeah, some profets kom meet am. Den God Spirit enter Saul body and e kon bigin tok like di profets.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ