But Elisha savant sey, “Make I give twenty bread to dis hundred men?” Elisha ansa, “Give am to di pipol make dem chop, bikos God sey, ‘Dem go chop taya and di food go remain.’ ”
One of di king ofisas ansa, “Abeg. Dat nor fit happen! Even if God ensef dey drop food from heaven, e nor go fit happen!” Elisha ansa, “Yu go si am dey happen, but yu nor go ever chop from am!”
Den Oga God tell Moses, “Naw, yu go si wetin I go do Fero. I go force am make e allow my pipol go. I go use my pawa take make am drive my pipol komot from dis land.”
Why my pipol nor ansa wen I go meet dem sey I go save dem? Why dem nor ansa wen I koll dem? I nor get pawa rish to save dem? But I fit kommand di sea make e dry kon turn river to desert, so dat di fish dem go die.
Why Yu bi like pesin wey nor know before dem attack am or like sojas wey nor fit save pesin? But my God, Yu still really dey with us! Wi bi yor pipol, abeg, make Yu nor abandon us.”
Bikos mi wey bi God go tok anytin wey I like and e go happen, just as I tok am: E nor go waste time again and na wen wiked pipol still dey alive. Yes! I go tok di word and e go happen just as I tok am.’ ”
“Mi God don tok. Di time don rish for mi to do wetin I won do. I nor go let una sin finish kon go like dat or sorry for una. I go ponish una for wetin una don do.” God wey get pawa don tok.