35 And wen dem karry di box dey travel, Moses go sey, “My God! Arise make yor enemies dem skata and make all doz wey hate Yu, run as dem si Yu dey kom.”
Oga God, make Yu raiz-up kon help us! Save us with yor pawa. Make Yu use yor pawa, just as Yu dey do before. Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea, na Yu kut am to pieces.
Wen di sojas kom back to dia kamp, Israel leaders kon sey, “Wetin make God let Filistia pipol win us like dis? Make wi karry God Kovenant Box from Shiloh, follow body. If di box dey with us, e go save us from awa enemies.”