Make una trit dem as una go trit una fellow Israel pesin. And make una love dem as una love unasef. Make una remember sey, una bi strenja for Egypt before. Na mi bi di Oga una God.
Doz wey nor get papa and mama and doz wey nor get husband again, E dey make sure sey E fight for dem. E dey show love to strenjas wey dey stay with una kon give dem food and klot to wear.
Moses fada-in-law shidren-shidren, wey bi Ken pipol, follow Judah pipol komot from Jeriko, di palm trees town, till dem rish di wildaness for Judah. Dem go stay with doz wey dey der, near Arad town for Negev.
By dis time, Heba, one Kenite man, komot from where en oda tribe pipol dey, go build en tent for near Kedesh, near one oak tree for Zaanannim. Na Moses broda-in-law wey Hobab bi en grand-grand papa.
Jonatan kon tell en savant, “Kom make wi go di oda side go meet all dis men wey dem nor sekonsaiz. May bi God fit fight for us. Nor-tin go fit stop God to save us, weda dem many or small.”