Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 1:46 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

46 na 603,550.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 1:46
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Den I go turn yu to one strong kountry kon bless yu. Yor name go dey great and yu go get betta blessing.


And I go make yor shidren-shidren plenty like san-san for di eart and nobody go fit kount dem.


God take am go outside kon sey, “Look di sky and yu go si di stars, den try if yu fit kount dem!” Den God sey, “Na as di stars bi for up, na so yor shidren go plenty rish.”


I go give yu many shidren and some of dem go bi kings. Yu go get many shidren and dem go get kountries.


I go really bless yu kon make yor shidren-shidren plenty well-well and nobody go fit kount dem, just as nobody fit kount stars for sky or di san-san wey dey near river. Yor shidren-shidren go take all di tins wey bilong to dia enemies.


Stay for dis land. Den I go dey with yu kon bless yu, bikos I go give all dis land to yu and yor shidren-shidren. I go do wetin I promise yor papa Abraham.


Yor shidren-shidren go plenty like san-san for groun and dem go skata go west, east, nort and sout. I go bless all di family for di world with yu and shidren-shidren name.


Dem tell di king about all di men wey fit do soja work and dem bi 800,000 from Israel and 500,000 from Judah.


Israel and Judah pipol plenty like san-san for wotaside; dem get enough food to chop and drink and dem dey happy.


E tell David, “Di men wey fit bi sojas for Israel na 1,100,000 and for Judah, dem bi 470,000.”


Abijah attack Jeroboam with 400,000 sojas and Jeroboam get 800,000 sojas.


Israel pipol bigin travel with leg from Rameses go Sukkot. Israel men wey travel rish 600,000 (Dem nor kount wimen and shidren join am).


Dis amount na di same for each pesin. Na di same as half shekel akordin to di Tabanako shekel, bikos di pipol wey plenty rish like dat from twenty years go up, na 603,550 dem bi.


All di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so for Israel wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names akordin to dia tribe and family,


But Moses ansa God, “I get 600,000, sojas with mi and Yu still dey sey, ‘I go give dem meat for one full mont!’


Una dead body go skata for dis wildaness, bikos una don komplain against mi. Nobody among una wey bi from twenty years go up, go enter di land.


Israel pipol wey dem kount akordin to dia group na 603,550.


Who go fit kount Jakob dust, dem too many to kount. Make I die as God pikin; make I die in peace as betta man.”


Di total nomba for Israel men wey dem kount na 601,730.


Wen una grand-grand papa dem go Egypt, dem bi only seventy. But naw, di Oga una God don make una plenty like di stars for sky!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ