Nehemaya 9:35 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
35 Even wen dem get dia kingdom, dem nor gri serve Yu, doh Yu still show dem yor goodness. Yu give dem betta land to plant, yet dem nor gri turn from dia wikedness.
Yor pipol seize strong-strong towns; betta-betta land; house wey propaty full; well wey dem don dig; olive trees; fruit trees and vineyards. Dem chop anytin wey dem wont kon fat and dem enjoy all di good tins wey Yu give dem.
I go tok about God love wey nor dey fail. I dey praiz am for wetin E don do for us. E don bless Israel pipol well-well, bikos of en mesi and love wey nor dey fade.
So Jeremaya, anytime wey yor pipol ask, “Wetin make di Oga God ponish us like dis? Make yu ansa, ‘Na bikos dem leave God go woship oda gods for dia land and bikos of dat, una must go serve as slave for anoda land.’ ”
But Jerusalem nor do wetin I kommand and e show sey e wiked pass di oda nashons. E disobey mi pass all di kountries wey dey round am. Jerusalem rijet my kommand and e nor gri receive my laws.
una go-go serve una enemies wey God go send against una. Una go dey hongry; una nor go si wota drink or get klot to wear and una nor go get anytin at-all. God go put load like iron for una neck wey go press una well-well until e don distroy una.
Den wen wahala and sofa fall for dia head, dis song go bi witness against dem, bikos dia shidren-shidren nor go forget am. I know wetin dem dey tink for dia mind today, even before I take dem go di land wey I promise dem.”