Awa Oga wey bi Israel God, Yu dey good. Wi, yor savants wey remain, kom meet Yu and wi dey konfess awa sins. Aldo wi nor get any rite to kom yor present again afta evritin wey wi don do.”
Na bikos Yu si as e dey faithful rish, naim make Yu make kovenant with am. Yu promise to gi-am Kanaan, Hit, Amor, Periz, Jebus and Girgash pipol land. Di land wey en shidren-shidren go stay and Yu keep yor promise, bikos Yu dey faithful.
My God, Yu dey always trit mi well anytime wey I komplain give Yu. But I ask Yu one kweshon about good judgement: “Why e bi sey wiked pipol dey prosper and pipol wey nor dey honest, dey susid?
Jerusalem sey, “God dey rite, bikos I go against en kommand. So pipol for evriwhere, make una listin kon si as I dey sofa! Dem don karry my shidren go Babilon as slave.