Nehemaya 9:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
30 Bikos of yor love, Yu dey patient with dem for many years. Yu send yor Spirit wey warn dem thru di profets. But yet, dem nor gri listin! So Yu allow oda nashons attack dem again.
But with all dis tins, di pipol go against Yu. Dem nor gri obey Yu and dem turn from yor law. Dem kill di profets wey kom warn and tell dem to turn kom meet Yu. Dem curse Yu many-many times,
Yu warn dem sey make dem obey wetin Yu tish, but dem rijet yor law bikos of pride and even doh yor law dey give life, dem nor gri obey am, bikos of dia strong head and sturbones.
Bikos God nor fit bear all di yeye tins wey una dey do, na dis make am turn una land to where pipol dey curse. E don skata am and pipol nor dey stay der again.
But na God do wetin E plan. E don do wetin E promise and E warn us about am since. E nor sorry for Jerusalem kon distroy am. E give awa enemies viktory and dem dey happy, bikos God don distroy us.
Two out of di seventy men, Eldad and Medad kon stay for di kamp and dem nor go where di Tabanako dey. But di Spirit enter dem for where dem dey and dem kon start to profesai too.
Nor bi sey God nor fit do wetin E promise as some pipol dey tink, but E dey patient dey wait for una, bikos E nor wont make anybody die trowey, but E wont make evribody turn from sin kom meet am.