Moses ansa, “Dis na wetin God tok: ‘Tumoro na Sabat Day, so evribody must rest. Anytin wey una won bake or boil, make una bake and boil dem today and anytin wey remain, make una keep am till di next day wey bi Sabat Day.’ ”
Make una know sey na bikos God sey make una rest for Sabat Day naim make am dey give una doubol food for di sixt day. So make evribody stay en house; make nobody komot en house for di sevent day.”
But make yu nor follow dem go, yu go dey here with mi, so dat I go fit tell yu all di kommand, rules and law wey yu go tish dem, so dat dem go dey do dem for di land wey I go give dem.”