Moses ansa, “Dis na wetin God tok: ‘Tumoro na Sabat Day, so evribody must rest. Anytin wey una won bake or boil, make una bake and boil dem today and anytin wey remain, make una keep am till di next day wey bi Sabat Day.’ ”
“God kom from Mount Sinai and E show ensef to Israel pipol for Seir; E shine kom from Mount Paran and E kom with 10,000 holy ones. Na en rite hand E take give dem en law.
E let una hear en vois from heaven, so dat E go fit tell una wetin una go do. E make una si en great fire for eart here, so dat E go tok to una from der.