For di third day, one yong man run kom from Saul kamp kon bow for David front. E dey kry with pain, bikos of wetin happen and e tear en klot kon pak dirty for en head.
For di twenty-third day for di sevent mont, Solomon kon tell all di pipol make dem dey go dia house. Dem happy well-well as dem dey go, bikos of di good tins wey God don do for David, Solomon and Israel pipol.
For where wi dey for Ahava River, I kon orda sey make all of us fast and honbol awasef before God and make wi ask am make E lead and protet us, awa shidren, all awa propaty and for awa journey.
“Go gada all Jew pipol for Shushan, den make una fast and pray for mi. Make una nor chop or drink anytin for three days and nites. Mi and my savants go do di same tin. Afta di fasting, I go-go meet di king, even doh dat kind tin dey against di law. If na dat one go make mi die, den make I die.”
Dis na wetin make God sey, “Make una turn from sin kom meet mi naw wey time still dey. Make una give mi una heart. Make una fast, kry and mourn as una dey kom meet mi.
“ ‘Wen una don harvest wetin una plant for una land, make una celebrate dis festival for seven days and e go start for di Fifteent day for di sevent mont. Di first day go dey special, so una go rest.
Afta dem don gada for Mizpa, dem kon draw wota pour put for God front. Dem nor chop for dat day and dem kon konfess all dia sins for der dey sey, “Wi know sey wi don sin against God.” So Samuel pray for Israel pipol for Mizpa.