Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nehemaya 8:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 All di pipol wey kom back from Babilon build house kon dey stay der. Dis na di first time wen dem dey do am afta di time wey Nun pikin, Jeshua do am and evribody happy well-well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nehemaya 8:17
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So dem chop and drink as dem dey happy for God present. Den dem kon dey shaut, “Na Solomon bi king.” Den, dem anoint am with God name as dia ruler kon make Zadok dia priest.


Di party for Jerusalem big pass anytin wey don happen for Jerusalem, since wen Solomon wey bi David pikin, bi king.


Dem neva do dis kind Passova for Israel since Profet Samuel die. No king for Israel don celebrate Passova like di way King Josaya, di priests, Levi pipol, Israel pipol, Judah pipol and all doz wey dey stay for Jerusalem, celebrate am.


E do evritin for di sakrifice, just as Moses tok about Sabat Day, New Moon festival and di three celebrashon wey dem dey do wey bi: Bread Wey No Get Yist Feast, Di Week Feast and Di Shelta Feast.


Dem celebrate Shelta Festival akordin to wetin dey di law and evriday, dem dey offa di sakrifice wey dem suppose offa


Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.


Una must celebrate dis feast for seven days to honor di Oga una God for di place wey E choose, bikos na en bless una well-well kon make all una work, prosper. Dis feast go bi time for evribody to happy.


All of dem faith still strong wen dem die and dem nor get di tins wey God promise dem, but dem si and welkom di tins from far and dem gri sey, dem diasef na strenja for dis world.


Na faith make am stay as strenja for di land wey God promise am. Na inside tent en, Isaak and Jakob wey go inherit di same promise, stay.


Bikos if to sey Joshua give dem rest, God for nor tok about anoda day.


Afta Moses, God savant don die, God kon tell Joshua wey bi Nun pikin wey bin dey help Moses sey,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ