11 Levi pipol kon go round dey tok to di pipol make dem nor kry, bikos today na holy day.
“Naw, make una go house go celebrate. Share food and wine with pipol wey nor get. Today na holy day for awa Oga God, so make una nor kry, bikos na God happiness dey make una strong.”
So all di pipol go dia house dey happy, dey chop and drink and share wetin dem get with one anoda, bikos dem undastand wetin dem read give dem.
Den Kaleb tell di pipol sey make dem shut up kon sey, “Wi go attack naw kon take di land; wi dey strong and wi go fit konker di land.”