7 Di leaders wey kom back with dem na: Zerubabel, Jeshua, Nehemaya Nahamani, Zabud (Seraya), Reelaya, Mordekai, Bilshan, Mispar, Bigvai, Rehum and Baanah.
Dia leaders na Zerubabel, Jeshua, Nehemaya, Seraya, Reelaya, Mordekai, Bilshan, Mispar, Bigvai, Rehum and Baanah. Dis na di list and di nomba of pipol from each family for Israel wey kom back from Babilon:
Wen Zerubabel, Shealtiel pikin and Jeshua wey Jozadak born hear dia message, dem kon start to ribuild di temple for Jerusalem and di two profet help dem.
Dis na di ofisas wey kom stay Jerusalem. (Some of di pipol, Levi pipol, priests, temple savants and Solomon savants shidren-shidren still dey stay dia own house for di difren towns wey dey Judah,
Dis na di pipol for di aria wey kom back from Babilon since King Nebukadnezzar karry dem go der as prisonas. Dem go back to dia towns for Jerusalem and Judah.
For di sekond year wen Darius bi king for Persia; for di first day for di sixt mont, God tell Profet Haggai make e give dis message to Zerubabel, Shealtiel pikin, wey bi govnor for Judah and to Joshua, Jehozadak pikin, wey bi di High Priest.