God put am for my heart sey make I koll all di pipol, dia leaders and ofisas togeda kon shek dia family rekord. I si di first set wey kom back from Babilon and dis na dia rekord:
Dis na some among di priests family wey nor get rekord to show sey dem bi Israel pipol: Hobaaya family, Hakkoz family, Barzillai (wey marry one of Barzillai dotas, wey bi Gilead pesin kon shange en name to en wife papa name) family.