44 Doz wey dey sing for di temple (Asaf shidren-shidren) family na 148.
From Asaf sons: Zakkur, Josef, Netanaya and Asarelah. Asaf wey dey profesai for di king, na-im dey lead dem.
Di temple muzicians (wey bi Asaf shidren-shidren) na 128.
Levi family wey kom back from Babilon na: Jeshua (Kadmiel wey Hodevah en papa, na en shidren-shidren) family and dem bi 74.
Doz wey dey guide di temple (Shallum, Ater, Talmon, Akkub, Hatita and Shobai shidren-shidren) dia family na 138.