Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nehemaya 6:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Dis na wetin dem rite for di leta: “Geshem tell mi sey, dem dey tok for evriwhere sey yu and Jew pipol won kom attack us and na dis make yu dey build di wall back. E still sey yu dey plan to make yorsef king

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nehemaya 6:6
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wi wont make di king know sey Jew pipol wey kom from yor oda aria, don dey stay for Jerusalem and dem dey build dat evil and yeye town back. Dem don start to build di wall and go soon finish am.


make yu orda make dem search for di rekord wey yor grand-grand papa keep. If yu do am, yu go si sey, before-before, di town too like wahala and e don give kings, kingdoms and rulers, many trobol. Di pipol for der, dey hard to rule and na dis make dem distroy di town.


Wen Sanballat, Tobaya and one Arab man wey en name bi Geshem, hear wetin wi dey plan to do, dem kon dey laf us sey, “Wetin una tink sey una dey do so? Una won fight against di king?”


Dem hire am make e for make mi fear den kon sin, so dat dem go spoil and disgrace my good name.


For di fift time, Sanballat send one savant with leta kon give mi.


and yu don arrange with some profet make dem announce for Jerusalem sey yu bi Judah king. Naw, di king go hear about am and na dis make mi sey make yu kom make wi first tok about di matter.”


I hear as pipol dey gossip mi. Dem dey koll mi, “Di Man Wey Fear One Kill.” Dem dey treaten sey, “If yu tok anytin here, wi go ripot yu.” Even my friends before, dey look and dey wait make I fall. Dem dey sey, “E go fall enter di trap, den wi go know sey wi don revensh am back.”


“God go bless una wey pipol dey curse, dey sofa and lie for una head, bikos of mi,


dey akuiz am sey, “Wi hear dis man wen e dey deceive and tell awa pipol sey make dem nor pay tax give Caesar and e dey tok sey naim bi Christ, wey bi king.”


Wen Pilate hear wetin dem tok, e bring Jesus kom out kon sidan for di chair for where e dey judge kase, (dem dey koll di chair, “Di Stone Pavement”, but na Gabbata dem dey koll am for Aramaik language.)


Den e go dey rite if wi sey, “Make wi dey do bad tins so dat good tins go kom out from wetin wi dey do?” But some pipol dey lie for my head, bikos of wetin I tok and God go ponish dem.


for di time wey dem honor or disgrace us; for di time wen dem tok bad about us or praiz us; di time wey dem do us like sey wi dey tok lie, but wi dey tok trut.


But make una do am with gentolness and respet, dey make sure sey una mind klean, so dat pipol wey dey tok bad about di good tins wey una dey do for Christ, go shame for di bad wey dem dey tok.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ