3 So I send message to dem sey, “I get betta work wey I dey do, so I nor go fit kom. I nor go fit stop di work, bikos I won kon si una.”
So I give di pipol swod, bow and arrow kon put some pipol for back of di walls and some for open space.
dem kon send message kom give mi sey make I kom meet dem for one village for Ono field. But I kon know sey dem dey plan to attack mi.
Dem send mi di same message four times and each time dem send am, I dey give dem di same ansa.
Doz wey nor get sense dey bilive evritin wey pipol tell dem! But wise man dey wosh en step.
So, anytin wey yu dey do, make yu do am well, bikos wons yu die, yor wisdom, knowledge, work and plans, nor go mean anytin again.
“Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.
Dem go sey, ‘Dis man start to build house and e nor fit finish am!’
I must do di work for di Pesin wey send mi before day go dark, bikos nite dey kom wen nobody go fit work.