Jew leaders kon dey progress well-well as dem dey build di temple, wey profet Haggai and Zekaraya enkourage dem to build. Dem komplete di temple, just as Israel God, King Cyrus, King Darius and King Atazazes for Persia kommand sey make dem do.
Afta wi don ribuild di wall and put all di gates for dia pozishon, I kon give doz wey dey guide di temple, doz wey dey sing for di temple and di oda Levi pipol, di work wey dem go do.
“So make yu know and undastand sey, ‘From naw wen I tell yu dis message, till di time wen dem go ribuild Jerusalem and di leader wey God choose go kom, e go bi seven weeks and sixty-two weeks. Dem go build di town well again, but wahala go dey for dat time.