Nehemaya 6:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
14 I kon pray, “My God, remember wetin Sanballat and Tobaya dey do, den make Yu ponish dem. Remember and ponish dat woman Noadaya and all di oda profets wey dey won make mi fear.”
My God, make Yu remember wetin Edom pipol do wen dem kon distroy and karry Jerusalem pipol komot from dia own land. Dem dey shaut, “Make una skata Jerusalem rish groun! Skata di town rish groun!”
Oga, na Yu bi my God and e don tey wen I dey wait for Yu, bikos my soul dey hongry for Yu. My whole body dey hongry for Yu inside dis dry and pash-pash land wey nor get wota.
I nor send doz profets, even doh dem dey lie with my name. Dem fit dey sey, ‘War and honga nor go dey for di land.’ But dis na wetin mi wey bi Oga God dey tok about dem: ‘Na war and honga go kill doz profets.’
Anytime I dey strol outside di town, doz wey dem kill for war, na dia dead body I dey si for road and wen I enter di town, I go still si sey pipol dey die, bikos dem nor si food chop. Profet and priest dey do dia work, but dem nor know wetin dem dey do.”
Dat same year, for di fift mont wey bi di fourt year wey Zedekaya bi king, Hananaya wey bi Azzur pikin, wey bi profet for Gibeon town kon tok to mi for di temple. For di priest and di pipol present, e sey,
If anybody si en broda or sista for Christ dey kommit sin wey nor go kill-am, make e ask God and God go give life to dat pesin. E get di kind sin wey dey kause deat and I nor sey make una pray make God forgive di pesin wey dey kommit dat kind sin.
So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.