Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nehemaya 6:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Dem hire am make e for make mi fear den kon sin, so dat dem go spoil and disgrace my good name.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nehemaya 6:13
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen I tink am again, I just know sey God nor tok to Shemaya, but na Sanballat and Tobaya bribe am make e for tok wetin e dey tok so.


Dis na wetin dem rite for di leta: “Geshem tell mi sey, dem dey tok for evriwhere sey yu and Jew pipol won kom attack us and na dis make yu dey build di wall back. E still sey yu dey plan to make yorsef king


If yu nid to choose between good name and plenty propaty, make yu choose good name, bikos respet betta pass silva and gold.


Pesin wey dey praiz en neighbour anyhow, dey set trap for dem.


To get good name betta pass perfume wey dear well-well and di day wen pesin die, betta pass di day wen dem born am.


Pipol wey know wetin dey rite, wey put wetin I dey tish dem for dia heart, make dem listin to mi. Make dem nor fear wen pipol dey curse dem.


God sey, “Who bi all dis gods wey make una dey fear and lie for mi? Wey make una forget mi like dis? Una don stop to honor mi, bikos I don too kwayet?


“But yu, Jeremaya! Make yu ready go tell dem evritin wey I kommand yu. Nor fear dem, if not, I go give yu betta rizin to fear dem.


Den di pipol sey, “Make una kom, make wi do sometin about dis Jeremaya! Wi go always get priest wey go dey to tell us wetin wi go do; wise pipol go dey wey go advise us and wi go always get profet wey go prish God word give us. So make wi lie against am kon stop to listin to anytin wey e tok.”


I hear as pipol dey gossip mi. Dem dey koll mi, “Di Man Wey Fear One Kill.” Dem dey treaten sey, “If yu tok anytin here, wi go ripot yu.” Even my friends before, dey look and dey wait make I fall. Dem dey sey, “E go fall enter di trap, den wi go know sey wi don revensh am back.”


But yu, my pikin, even doh dem beat and do yu anyhow like sey yu dey stay with skorpions, make yu nor fear dem or anytin wey dem tok. Nor fear anytin wey dem tok or di way wey dem go dey look yu, bikos all of dem sturbon well-well.


Make una nor fear who go fit kill di body and nor fit kill di soul. Instead, make una fear God wey fit distroy pesin soul and body for hell-fire.


Den di Farisee pipol komot go plan how dem go take katch Jesus with wetin e go tok.


Di priest oga dem and di Sanhedrin kon dey find wetin dem go take whole Jesus, make dem for fit kill-am.


Dem bring pipol kon lie sey, “E don tey wey dis man dey tok bad-bad tins about Moses Law and dis Temple.


And I go kontinue to do wetin I dey do, so dat doz apostles nor go get rizin to boast sey, dem dey do di same work with us.


So I wont make di yong wimen marry; born shidren; dey guide dia house, so dat enemies nor go get shance to akuiz dem.


Bikos God nor give us di spirit wey go make us fear, but di spirit wey E give us, get pawa, love and sef kontrol.


Make yu prish di trut, so dat pipol nor go get rizin to tok against yu. Den doz wey dey oppoz yu, go shame and dem nor go get word to tok about us.


So anybody wey know wetin good and e nor do am, don kommit sin bi dat.


But for pipol wey fear nor dey let dem do wetin good; doz wey nor bilive mi, doz wey nor dey obey mi; doz wey kill odas; pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey do majik; pipol wey dey serve juju and evribody wey dey tok lie, na inside di fire and sulfur dem go-go. And na dat bi di sekond deat.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ