Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nehemaya 5:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 I kon sey, “Just as wi fit, wi don dey buy awa Jew brodas wey sell demsef give strenjas back. But naw, una by unasef won sell una own brodas! So how many times wey go buy dem back?” But di leaders kwayet and nor fit defend diasef.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nehemaya 5:8
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den I sey, “Wetin una dey do so nor good! Una nid to respet God and dey do wetin korrect. Den una nor go give awa enemies wey bi Gentile pipol, any shance to laf us.


Even di pesin wey dey important pass, go shut up for mi.


“Job, yor words too strong for all of dem; dem nor get ansa for yu.


“Anybody wey kidnap and sell pesin or dem katch di pesin for en hand, dem must kill-am.


So di king ask am, ‘My friend, how yu take enter here wen yu nor wear marriage klot?’ But di man nor fit ansa am.


E give one five koins, give anoda one two koins and di last, one koin. E give each savant wetin e go fit use, den e kon travel.


Bikos di pesin wey get sometin go get more and wetin e get, go plenty. But di pesin wey nor get, even di small one wey e get, dem go take am from am.


Bikos if di food wey yu chop make yor broda or sista vex for yu, den yu nor dey show love again. So make yu nor let di kind food wey yu dey chop, offend di pesin wey Jesus Christ die for.


Wi know sey wetin di law tok, na for di pipol wey dey under di law. Di law tok like dis, so dat nobody go get eskuse wen God go judge di world.


Den wetin yu know don distroy pesin wey Christ die for.


Bikos if e really dey una mind to do am, anytin wey una give akordin to wetin una get, God go asept am, but nor bi wetin una nor get.


So anytime wey wi get shance, make wi dey do good, especially to pipol wey bi God shidren.


If una katch pesin wey kidnap anoda Israel pesin kon dey trit am like slave or sell am, di pesin wey kidnap anoda pesin, must die. Like dis, una go remove bad-bad tins from among una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ