Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nehemaya 5:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Wi bi Jew pipol too, awa shidren bi like dia own shidren. But wi sell awa shidren as slave give dem. Dem don sell some among awa dotas as slave. Wi nor get pawa or who go help us, bikos dem don take awa farms and vineyards from us.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nehemaya 5:5
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Laban tell am, “Yu really bi my own flesh and blood.” So Jakob stay with Laban for one mont.


So make wi sell am give dis Ishmael pipol, but make wi nor kill-am, bikos e still bi awa broda; awa flesh and blood.” En brodas kon agri with wetin e tok.


One day, one woman wey en husband bi profet before e die kon kry go meet Elisha sey, “Yor savant my husband don die. Yu know sey yor savant dey follow God kommand. Naw, doz wey e dey owe money before e die, won kom take my two sons as slave.”


Na rish pipol dey rule poor pipol and if yu borrow money from pesin, yu go bi en savant.


Dis na wetin God tok: “Una tink sey I drive my pipol komot like man wey drive en wife komot en house? Where di leta wey I take drive una mama? Una tink sey I sell una as slave like man wey sell en shidren? No! Una bi slave, bikos of una sins and dem karry una komot from una land, bikos of di bad-bad tins wey una do.


Make una share una food with pipol wey dey hongry kon open una door for poor pipol wey nor get house. Den give klot to pipol wey nor get anytin to wear and help una own rilashons.


Bikos e nor fit pay wetin e whole, di king kon orda make dem sell di man, en wife, en shidren and evritin wey e get, take pay di debt.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ