Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nehemaya 5:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Some odas still sey, “Wi borrow money take pay di royal tax for awa farm and vineyards.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nehemaya 5:4
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Doz wey kom from Ammon, Het, Periz, Hiv and Jebus dey too and dia shidren still bi slaves for Israel till today.


Awa oga, if dem build dis town back kon komplete di wall, di pipol go stop to pay tax and di money wey yu dey get for di palis bag, nor go rish again.


Kings wey get pawa don rule for der before and dem rule di whole West Eufrates aria, dey kollect tax and oda money.


Nor kollect any tax from di priests, Levi pipol, muzicians, guards or doz wey dey work for di temple.


Odas sey, “Wi don use awa farm, vineyard and house take-take loan, so dat wi go get enough food to chop, make honga nor kill us.”


Di king wey Yu put ova us, bikos wi sin, na-im get evritin wey di land dey produce. Na wetin dem like dem dey do with wi and awa animals and wi really dey sofa for dia hand.


Na rish pipol dey rule poor pipol and if yu borrow money from pesin, yu go bi en savant.


Efraim pipol nor fit win all Kanaan pipol wey dey stay Geza. So Kanaan pipol still dey stay with Efraim pipol till today and dem bi Efraim pipol savant.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ