Den Judah tell en papa Israel sey, “Make yu allow di boy follow mi and wi go-go togeda. Den wi go dey alive and wi nor go die, both wi, yu and awa shidren.
Wetin go make us die for yor eye; both wi and awa land. Make yu buy wi and awa land and wi and awa land go bi Fero own. Just give us food, so dat wi nor go die. Den di land nor go dey empty.”
One day, one woman wey en husband bi profet before e die kon kry go meet Elisha sey, “Yor savant my husband don die. Yu know sey yor savant dey follow God kommand. Naw, doz wey e dey owe money before e die, won kom take my two sons as slave.”
Una plant many korn, but wetin una harvest, small. Una get food to chop, but e nor dey beleful una. Una get wine to drink, but e nor dey rish una! Even wen una wear many klot, e nor dey make una warm and pipol wey dey work, dia salari nor dey rish dem spend.
Una must honor mi with wetin una dey do, but if una nor gri listin to wetin I dey tok, I go curse una. I go bikos of wetin una do, curse evritin wey una get. True-true, I don already curse una, bikos una nor gri honor mi.