Nehemaya 4:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
16 From den go, half among my men dey work and half dey guide, dem wear war klot and hold spears, shields and bows. And di leaders really support di pipol
Awa enemies hear sey wi don know di plan wey dem dey plan against us and dem know sey God don make dia plan fail. Den all of us kon go start to build again.
For dis time, mi, doz wey dey follow mi, my savant and my bodyguards, nor dey shange klot at-all. And all of us keep awa swod, bow and arrow for where wi go kwik take am even fit na wota wi dey drink.
All of dem sabi use swod well and dem train dem well to fight war. Each of dem swod dey near dia waist and dem dey guide against anybody wey won attack dem for nite.