13 So I give di pipol swod, bow and arrow kon put some pipol for back of di walls and some for open space.
So from time to time, Jew pipol wey dey stay among awa enemies, dey kom tell us di plan wey di enemies dey plan.
So I send message to dem sey, “I get betta work wey I dey do, so I nor go fit kom. I nor go fit stop di work, bikos I won kon si una.”
Pipol wey dey dash oda pipol money, dey do dia business well and na dem good tins dey follow.
“Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.
My brodas and sistas, make una stop to tink like small shidren. Instead make una dey tink like mature pipol and dey innocent like pikin wey dem just born.