For dis twenty years wen I dey for yor house. I serve yu for fourteen years for yor two dotas and six years for di animals, but yu still dey short-pay mi anyhow.
Any matter wey koncern wisdom and knowledge wey di king ask dem, e dey si sey dia ansa betta well-well pass di ansa wey all di wise men, majik pipol and di pipol wey dey tok wetin go happen for future, dey give.
non of dis pipol go dey alive to enter di land. Dem don si my glory and mirakle wey I do for Egypt and for di wildaness, but dem don too try my patient, bikos dem nor gri obey mi.