Afta dis, Manasseh build di outside wall for David Town for di west side for Gihon Valley go rish di Fish Gate and di oda gates. E make am high well-well kon put sojas for evriwhere for di town wey dem fence for Judah.
I still ask di king make e give mi leta wey I go give Asaf wey dey guide di royal forest, so dat e go give mi big-big woods make I take build di guide gate for di temple, di town wall and di house wey I go stay. So di king give mi all wetin I wont, bikos God dey with mi.
Meremot wey Hakkoz pikin Uriaya born, ripair di next part. While Meshullam wey Meshezabel pikin Berekaya born, do di next part. Na Zadok, wey Baanah born, ripair di oda part.
Wen Sanballat, Tobaya, Geshem and di rest of awa enemies hear sey wi don build di wall tight well-well, even doh wi neva set di gates for where dem suppose dey,
Afta wi don ribuild di wall and put all di gates for dia pozishon, I kon give doz wey dey guide di temple, doz wey dey sing for di temple and di oda Levi pipol, di work wey dem go do.
God sey, “For dat day, pipol go kry dey kom from di Fish Gate and dem go dey shaut from di new house dem wey dey di town. And una go hear strong nois from di hills.