22 Na all di priests from di aria wey dey near der, ripair di rest part for di wall.
Dem bring doz wey dey sing from evriwhere for Jerusalem and from di village dem wey dey Netofat.
Meremot wey Hakkoz pikin Uriaya born, ripair di next part go rish di end for Eliashib house.
Benjamin and Hasshub, ripair di next part wey dey front of dia house. Zabud wey Ananaya pikin Maaseaya born, ripair di next part wey dey en house front.
dem kon send message kom give mi sey make I kom meet dem for one village for Ono field. But I kon know sey dem dey plan to attack mi.