Di remainin tins wey Hezekaya do, plus all wetin e get and how e build pool where wota go from dey kom di town, dem rite am put for Judah kings history book.
Levi pipol wey ripair di next parts na, Rehum wey bi Bani pikin, while Hashabaya wey dey rule half of Keilah aria, ripair di next part for en aria pipol.
Una make somewhere inside di town where una go dey store wota wey dey flow kom from di old pool. But una nor trust God wey make am. Una nor gri depend on God wey make all dis tins.
So God tell Isaya, “Make yu take Shear-Jashub yor pikin go meet King Ahaz. Yu go si am for di side where wota for dey kom di pool, where pipol for dey wosh klot.