12 Shallum wey Hallohesh born, wey bi ruler for di oda half of Jerusalem aria, ripair di next part and en dotas help am for di work.
Refaaya wey Hur born, wey dey rule half of Jerusalem aria kon ripair di next part.
Doz wey dey guide di temple (Shallum, Ater, Talmon, Akkub, Hatita and Shobai shidren-shidren) dia family na 138.
All di wimen wey know how to weave and sew bring wetin dem don weave; both blue, purpol and red wool with fine linen.
Yes, my good friends, I still dey tell una, make una help dem. Dem try as dem dey prish di gospel with mi, both Klement and my oda ko-workers, wey dia name dey inside Christ Life Book.