Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nehemaya 2:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Den di king ask, “Na wetin yu wont naw?” So I kwik-kwik pray to God wey dey heaven,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nehemaya 2:4
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen dem tell David sey Ahitofel don join Absalom against am, e kon pray, “Oga God, I beg! Make any word or advise wey Ahitofel tok, dey yuzles!”


One nite wen Solomon dey Gibeon town, God kon appear and ask am for dream sey, “Solomon, make yu ask mi for anytin wey yu wont and I go give yu.”


Make Yu listin to di prayers wey mi and yor savants wey dey honor Yu, dey pray. Make Yu help mi today, so dat di king go sorry for mi.” For dat time, na mi dey serve di king wine.


Wen I hear all dis tins, I sidan kry well-well and I nor chop for many days. Den I pray to God sey,


“Oga God for heaven! Yu big well-well and wi dey fear Yu. God wey keep en promise with doz wey love and dey do wetin E kommand.


I ansa dem, “God wey dey heaven go give us viktory. Wi bi en savants and wi go start to build. But una nor get rite, share or anytin to klaim for Jerusalem.”


den I ansa, “If my king dey happy with mi and go gri do wetin I wont, den make yu allow mi go Judah town, where dem beri my grand-grand papa dem put, so dat I go fit ribuild am.”


Di king ask am, “My kween, wetin dey happen? Make yu tell mi anytin wey yu wont (even if na half of my kingdom), I go gi-am to yu.”


As dem dey drink, di king kon ask Estha, “Make yu tell mi wetin yu wont and I go do am for yu; even if na half of my kingdom yu ask for.”


for di sekond time. As dem dey drink wine, di king kon ask Estha, “My kween, na wetin yu wont make I do for yu? Make yu tell mi and I go do am for yu. I go even give yu half of my kingdom.”


So make wi tank di Oga God wey dey heaven, bikos en love wey nor dey fail, dey forever!


Always dey remember God kommand for anytin wey yu dey do, den E go show yu di korrect way.


Den Jesus ask am, “Wetin yu wont make I do for yu?” Di blind man ansa, “Tisha, make my eye open, make I for fit si again.”


Di kommanding offisa whole di boy for hand go one korna kon ask am, “Wetin yu won tell mi?”


Make una nor let anytin worry una for mind. Instead, for evry kondishon wey una dey face, make una ask God thru prayer for evritin wey una nid and make una always dey tank am, as una dey pray.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ