Nehemaya 2:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
10 But wen Sanballat, wey kom from Bet-Horon town and Tobaya, one offisa for Ammon aria, hear sey somebody don kom help Israel pipol, dem kon dey vex well-well.
Naw, Eliashib wey bi di priest born Joiada, but one for Joiada pikin marry Sanballat dota, wey kom from Bet-Horon town, so I sey make Joiada komot from Jerusalem.
Wen Sanballat, Tobaya and one Arab man wey en name bi Geshem, hear wetin wi dey plan to do, dem kon dey laf us sey, “Wetin una tink sey una dey do so? Una won fight against di king?”
Sanballat, Tobaya with Arab, Ammon and Ashdod pipol kon dey vex well-well wen dem hear sey wi still dey ribuild Jerusalem wall and kover all di holes wey dey.
Wen Sanballat, Tobaya, Geshem and di rest of awa enemies hear sey wi don build di wall tight well-well, even doh wi neva set di gates for where dem suppose dey,
So Mordekai wey bi Jew kon bi next to King Zazes. En pipol wey bi Jew dey respet, honor and like am well-well. E work make e for good for en pipol, so dat dia shidren-shidren nor go sofa.
My heart dey kry for Moab pipol, bikos di pipol don run go Zoar, Eglat and Shelishiyah town. Some even dey kry as dem dey go Luhit, while odas eskape go Horonaim town.