And wen King Atazazes dey rule for Persia, Bishlam, Mitredat, Tabeel and some pipol wey dey follow dem, rite leta go give di king. Dem rite di leta for Aramaik language, but dem go tok di meaning wen dem dey read am.
Afta all dis tins don happen, for di time wen King Atazazes dey rule Persia, one man wey en name na Ezra kon kom from Babilon. E trace en grand-grand papa family kon know sey e kom from Aaron, di High Priest family. Ezra na Seraya pikin and na Zabud wey Hilkaya born, bi Seraya papa.
For di sevent year wey Atazazes dey rule, Ezra komot from Babilon go Jerusalem with some Israel pipol and some among dem na priests, Levi pipol, doz wey dey sing for di temple, temple guards and workers.
Dis na di tins wey Hakalaya pikin, Nehemaya do. For di twenteth year, for Kislev mont, wen Atazazes bi king for Persia, mi, Nehemaya, dey Shushan, wey bi di palis.
Make Yu listin to di prayers wey mi and yor savants wey dey honor Yu, dey pray. Make Yu help mi today, so dat di king go sorry for mi.” For dat time, na mi dey serve di king wine.
For di twelft year wen King Zazes dey rule, for di first mont wey bi Nisan, Haman kon sey make dem trow dice (na Purim dem dey koll am), so dat e go know di rite day and mont to do wetin e plan. E kon agri to do en plan for di thirtint day for di twelft mont, wey bi Adar.
“So make yu know and undastand sey, ‘From naw wen I tell yu dis message, till di time wen dem go ribuild Jerusalem and di leader wey God choose go kom, e go bi seven weeks and sixty-two weeks. Dem go build di town well again, but wahala go dey for dat time.