Nehemaya 13:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English5 E build one big room where dem bin dey keep korn ofrins and incense, di tins wey dem dey use for di temple, di ofrin wey bi priests own and one from evry ten tins wey pipol bring from dia korn, wine and olive oil wey dem give Levi pipol and doz wey dey guide and sing for di temple. အခန်းကိုကြည့်ပါ။ |
Di bread wey wi make from di first korn wey wi harvest for each year and oda ofrin like wine, olive oil and difren kind of fruits, wi go-go give dem to di priest for di temple. Wi go give Levi pipol one out of evry ten tins wey wi get from evritin wey wi plant for awa farm, bikos na dem dey kollect am.
Dat day, dem kon pick men wey go dey guide di store room for di ofrins, di first part for di harvest and one out of evry ten tin wey dem give God. Na dem dey kollect money from di field outside di town and di part wey di law give di priest and Levi pipol. All di pipol for Judah dey happy, bikos of di work wey Levi pipol and di priests dey do.