Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nehemaya 13:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 For dat time, I notis sey many among Jew men marry wimen from Ashdod, Ammon and Moab town.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nehemaya 13:23
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Solomon kon love many wimen wey kom from oda kountry. Apart from Fero pikin wey bi en wife, e still marry plenty wimen from Hit, Moab, Ammon, Edom and Sidon kountries.


Priest Ezra stand up kon tell dem, “Una don kommit strong sin as una go marry doz wimen wey bi strenjas. Una don add join Israel wahala.


Na all dis men marry wimen from anoda kountry. Dem divorce dem kon porshu dem and dia shidren kom from Israel.


Wi promise sey awa dota nor go marry di strenjas wey dey stay for awa land.


Wi still promise sey wi nor go buy korn or anytin wey strenjas go karry kon sell for us for Sabat Day or for any oda day wey holy. For evry sevent year, wi nor go plant anytin for di land and wi go kounsol all di debt wey pipol dey owe us.


Wen dem dey read Moses law give di pipol, dem kon rish di place wey sey make dem nor allow any Ammon or Moab pesin join God pipol.


Half of dia shidren dey speak Ashdod language (or some oda language), but dem nor fit speak Hibru language.


So e good make wi dey hear all dis una wiked tins and how una disobey awa God and marry wimen from oda kountries?”


Sanballat, Tobaya with Arab, Ammon and Ashdod pipol kon dey vex well-well wen dem hear sey wi still dey ribuild Jerusalem wall and kover all di holes wey dey.


Make yu obey wetin I dey kommand yu today. I go drive Amor, Kanaan, Hit, Periz, Hiv and Jebus pipol komot for una.


Make una nor make friend with pipol wey nor bilive, bikos, na wish kind friend raitiousness and bad tin won bi, or na wetin lite and darkness get togeda?


Wen di Oga una God take una enter di land wey una go-go stay, E go porshu many kountries komot for una. Kontries like: Hit, Girgash, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol. (Di pipol for dis seven kountries get pawa pass una.)


So di shidren marry wimen from Moab and dia name na Orpah and Rut. Dem kon stay for Moab for anoda ten years.


Naw, Filistia pipol don karry God Kovenant Box from Ebeneza go Ashdod.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ