So I kon give orda sey make dem dey lock di town gate for morning go rish evening for evry Sabat Day and make dem nor open am until dat day finish. I put some among my men for di gate, make dem make sure sey dem nor karry anytin enter or go outside di town for Sabat Day.
So I warn dem, “No nid to dey wait for outside till morning. If una try am again, I go ponish una.” From dat time go, dem nor kon dey kom der for Sabat Day.