So I kworel with di leaders kon ask dem, “Wetin make una forget God Temple?” Den I go bring Levi pipol and doz wey dey sing kom back to di temple, so dat dem go start dia work again.
Afta I tink about am well-well, I kon tok against di ofisas and doz wey get money. I tell dem, “Una dey opress and ponish una own brodas as una dey take intrest wen dem borrow money from una!” Bikos of dem, I kon koll evribody togeda make dem tok for di matter.
I go-go meet and tok to di leaders, bikos dem know wetin God wont and wetin E sey make dem do.” But even dem too don rijet God and nor gri obey en kommand.
“But even as dem dey wildaness, dem rijet mi. Dem break my laws kon rijet my kommand wey dey give life to doz wey dey obey am. Dem distroy di Sabat finish. Wen dem dey di wildaness, I dey ready to make dem feel as my vexnashon strong rish.