Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nehemaya 13:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Den Israel pipol kon start to dey bring one out of evry ten korn, wine and olive oil kom di temple store room again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nehemaya 13:12
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E give orda sey make di pipol for Jerusalem bring dia own part wey dem go share give di priest and Levi pipol, so dat dem go obey God kommand.


Wen dem give di orda, Israel pipol bring dia grain, wine, olive oil, honey and all wetin dem get for dia farm. Dem bring one for evry ten tins wey dem get and dem plenty well-well.


Dat day, dem kon pick men wey go dey guide di store room for di ofrins, di first part for di harvest and one out of evry ten tin wey dem give God. Na dem dey kollect money from di field outside di town and di part wey di law give di priest and Levi pipol. All di pipol for Judah dey happy, bikos of di work wey Levi pipol and di priests dey do.


“ ‘One out of evry ten tin for wetin grow for di land, weda na grain or fruit, go bi God own.


“Make una bring one out of evry ten tins wey una get kom my temple, so dat food go dey der. Den make una try mi, weda I nor go open heaven kon pour many-many blessings for una head.


E dey good for pesin to shit God? No! But una dey shit mi and una dey ask, ‘How wi take dey shit Yu?’ Na for di matter wey koncern una ofrin and one out of evry ten tins wey una get.


Una must make sure sey una dey give God one from evry ten tin wey una get or harvest dat year.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ