Dem sey make dem go koll di king kom, so Hilkaya pikin, Eliakim wey dey guide di palis, with Shebna wey dey rite wetin dey happen for di palis and Joah pikin Asaf wey bi di palis seketry kon go meet dem.
and Jeshua wey Jehozadak born, en fellow priests, Zerubabel wey bi Shealtiel pikin and en family membas kon build di Oga wey bi Israel God altar back, so dat dem go fit dey burn sakrifice for der akordin to wetin dem rite for God savant, Moses Law.
For di sekond year wen Darius bi king for Persia; for di first day for di sixt mont, God tell Profet Haggai make e give dis message to Zerubabel, Shealtiel pikin, wey bi govnor for Judah and to Joshua, Jehozadak pikin, wey bi di High Priest.