Nehemaya 12:42 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
42 and doz wey dey sing na: Maaseaya, Shemaya, Eleazar, Uzzi, Jehohanan, Malkijah, Elam and Ezer. Dem play kon dey sing well-well and na Jezrahaya bi di kwayamasta.
For dat day wen pipol dey happy, dem offa many sakrifice, bikos God don give di pipol rizin to dey happy. Di wimen and shidren still join for di celebrashon and evribody from far know sey betta tin dey happen for Jerusalem.