So dem go Samaria kon tell di guards wey dey di gate sey: “Wi go Siria sojas kamp and wi nor si anybody for der; dem run leave all dia horse and donkey and di tent bi as dem leave am.”
Na dem dey kare for di tent where dem for dey meet and di holy place. Dem still dey help dia brodas wey bi Aaron shidren-shidren, wey dey serve for God Temple.
As en papa David tok, Solomon choose difren priests to do difren tins. E choose Levi pipol wey go dey lead woship and help di priest for dia work evriday and doz wey dey guide di gate. Dis na wetin David, God savant tok.