Dem keep one book about Levi family for di time wen Eliashib, Joiada, Johanan and Jaddua dey serve as High Priest. Anoda rekord for di priest dey for di time wen Darius dey rule Persia.
Naw, Eliashib wey bi di priest born Joiada, but one for Joiada pikin marry Sanballat dota, wey kom from Bet-Horon town, so I sey make Joiada komot from Jerusalem.
Eliashib wey bi di high priest and en oda priests build di Sheep Gate, dedikate kon put di doors as dem suppose dey. Dem build go rish di Hundred Towa and Hananel Towa kon dedikate dem too.