Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nehemaya 11:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 but some among di pipol for Judah and Benjamin go back to Jerusalem, na dem bi.) From Judah tribe: Uzzaya wey Zekaraya pikin Ataya born and na Amaraya born Zekaraya. Na Shefataya wey Perez pikin Mahalalel born, bi Amaraya papa.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nehemaya 11:4
7 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But di pikin take en hand go inside back and en broda kon kom out before am. Tamar sey, “Si as yu take kom out from my belle!” So e koll di pikin, Perez.


Dis na di ofisas wey kom stay Jerusalem. (Some of di pipol, Levi pipol, priests, temple savants and Solomon savants shidren-shidren still dey stay dia own house for di difren towns wey dey Judah,


Wi still get Maaseaya wey bi Baruk pikin and na Kol-Hozeh wey Hazaya born, bi Baruk papa. Hazaya na Adaya pikin wey Joiarib born and na Zekaraya wey Shelah born, bi Joiarib papa.


Judah born Perez and Zera (wey en mama bi Tamar), Perez born Hezron and Hezron born Ram,


Amminadab wey bi Admin pikin, naim born Nashon. Admin papa na Arni, wey bi Hezron pikin, wey bi Perez pikin wey Judah born.


Na Perez family bi dis: Perez na Hezron papa


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ